29 Den yu go santify dem and dem go dey holy. Anytin wey tosh dem go dey holy too.
For seven days, yu go make sakrifice for di altar kon santify am, den di altar go dey holy and anytin wey tosh di altar, go dey holy too.
di burnt ofrin altar and evry oda tin, di basin and en lampstand.
Yu go anoint and santify Aaron and en sons, so dat dem go fit serve as my priest.
Den yu go anoint di altar for di burnt ofrin with all en tins kon santify di altar and e go bi di altar wey dey holy pass.
Evry boy pikin wey Aaron born, must chop am. Na dis go always bi dia share wen ever dem offa ofrin to God. God go ponish anybody wey tosh di food ofrin, bikos e dey holy.’ ”
Den Moses use di anointin oil take anoint di Tabanako and evritin wey dey inside, so dat e go dey holy.
E sprinkol some anointin oil for di altar seven times; plus di vessels, wosh-hand basin and dia stand, so dat all of dem go dey holy.
Wen Moses don set di Tabanako finish, e kon anoint and dedikate di tent, di altar and evritin wey dey inside.
Una bi fool wey blind! Wish one big pass, na di gold or di temple wey make di gold holy?
Una blind o-o! Wish one big pass, na di gift or di altar wey make di gift holy?