Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 30:18 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

18 “Yu go still make bronze basin with bronze stand. Yu go put wota inside am kon put am between di tent wey dem for dey do meetin and di altar.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 30:18
15 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Hiram still make di big bronze basin wey dem dey koll “Di Sea.” E deep rish seven and half fit kon long and wide rish 15 and 45 fit.


Hiram still make ten basin for each kart. One basin wide rish 6 fit wey go kontain 200 gallon of wota.


E still make one bronze basin kon koll am “Di Sea.” If dem measure am from one side to di oda, na 15 fit e bi; e round for shape kon high rish seven and half fit. Di basin round rish 45 fit.


E make ten basin wey dem fit take wosh: E put five for di sout and five for di nort side. Na inside di basin dem for dey wosh di tins wey dem dey take do di burnt sakrifice; but di priest dey wosh inside “Di Sea.”


di burnt ofrin altar with all di tins wey e dey use; di basin with en stand;


E make di bronze basin and en bronze stand from di mirror wey bilong to di wimen wey dey serve for di Tabanako gate.


And yu go put di basin between di tent where dem for dey do meetin and di altar, den pour wota inside.


Make yu dey kareful wen yu enter God temple, bikos to kom meet God make E tish yu, betta pass foolish sakrifice and pipol wey dey offa am, nor know sey wetin dem dey do, nor good.


E sprinkol some anointin oil for di altar seven times; plus di vessels, wosh-hand basin and dia stand, so dat all of dem go dey holy.


God sey, “For dat day, I go open one place where wota go for rush kom wosh David shidren-shidren and Jerusalem pipol from all dia sins and all di bad-bad tins wey dem dey do.


E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.


But if wi dey inside di lite as en ensef dey inside lite, all of us go bi en friend and Jesus wey bi en pikin, go use en blood take wosh all awa sins komot.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ