12 “Wen ever yu dey kount Israel pipol akordin to dia nomba, anybody wey dem kount go pay for en life to di Oga dia God, so dat bad tin nor go happen to dem wen yu dey kount dem.
“Three years wey food nor go too dey; or three monts wey una go dey run from una enemy sojas; or three days wey God go attack una with sickness and en angel go bring deat kom dis land? Na wish one yu wont make I tell God?”
Joab ansa, “God go make Israel pipol many pass di way dem bi naw! But my oga! All di pipol na yor own, wetin make yu won do dis tin kon put di whole kountry for wahala?”
Joab wey en mama na Zeruaya kon bigin kount di pipol, but e nor komplete am. God kon ponish Israel for wetin dem do, so dem nor fit rite di real nomba for King David own book.
So, di king koll Priest Jehoiada kon sey, “Wetin make yu neva tell Levi pipol make dem kollect di tax from Judah and Jerusalem pipol, just as dem rite am for God savant Moses book?”
So wi dey bring di gold ornaments, armlets, bracelets, rings, ear-rings and necklaces wey each of us take. Wi give dem to God as payment for awa life, so dat E go protet us.”