Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 30:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 Wons evry year, Aaron go klean di altar with blood from di horn and dem go dey do like dis from one generashon go rish anoda, bikos e dey holy to Oga God.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 30:10
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Adonijah kon dey fear Solomon so e go di tent for God present kon hold di horn wey dey di altar.


Na Aaron and en shidren-shidren dey offa sakrifice for God altar. Na dem dey kare for di holy place and for all di sakrifice wey go make God forgive Israel pipol dia sins. Dem do all dis tins, just as Moses kommand dem.


Make yu nor burn incense wey nor holy for di altar or any bad animal, korn or even pour drink ofrin on-top di altar.


Na like so e go take do sakrifice for di Holy Place for Israel pipol sin. E go still do sakrifice for di tent, bikos di tent dey centre for di kamp even as dem nor dey holy.


den e must go di altar wey dey before God kon santify am. E must take some of di melu and goat blood kon put am for front for di altar korna.


“Make yu tell yor broda Aaron sey, na di rite time e go-go di place wey holy well-well for di curtain back, bikos na for der I appear for kloud on-top di Kovenant Box. If e nor do am, e go die.


“Di tent day for di sevent mont go bi di day to pray make God forgive una. Una go gada woship and una nor go chop anytin, but una go give ofrin to God.


Den e go put some blood for di horn for di incense altar wey dey di tent. E go pour di blood wey remain for under di altar wey dem dey use take dey burnt sakrifice wey dey di tent gate.


Den e go put some of di blood for di horn for di incense altar wey dey di tent. E go pour di blood wey remain under di altar wey dem dey use take dey burn ofrin, wey dey di tent gate.


Na dis pikin bi God image and e dey show God glory. Naim dey keep evritin wey dey dis world with en pawa. Afta e don die make God for forgive evribody dia sins, e kon go sidan for God rite side for heaven.


Christ nor nid to offa ensef evry year like di High Priests dey do for di temple with animal blood,


But na only di High Priest dey enter di Holy Place wons a year. For der, e go first offa blood for en sins, before e go offa for di pipol own, bikos dem nor know wetin dem suppose to know.


Den di sixt angel blow en trumpet and I hear one vois dey tok from di for horns wey dey di gold altar for God present.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ