Den God angel tell Hagar, “Yu get belle naw and yu go soon born boy pikin. Yu go name am ‘Ishmael,’ bikos di Oga God don hear yor kry and si yor pains.
Di angel sey, ‘Make yu si and know sey, all di goats wey sleep with di oda animals, get spot, mark and dem black, bikos I don si evritin wey Laban dey do yu.
“Make yu go back go meet Hezekaya, wey dey rule my pipol kon tell am sey, ‘Mi God wey bi yor grand-grand papa David God don hear yor prayer and si as yu dey kry. I go heal yu and afta three days yu go-go back to di temple.
So God ansa, “Bikos of di wiked tins wey dem don do to pipol wey nor get help and di pains wey poor pipol dey face, I go do sometin; I go fight for dem, bikos na so dem wont make I do since.”
Den I tink of all di wiked tins wey dey happen for dis world. I si pipol wey dem dey opress, dey kry and nobody dey to help dem. Nobody dey to save dem from doz pawaful men wey dey opress dem.
Nor sopraiz wen dem dey opress poor pipol or as bad judgement dey kover good judgement. Dis na bikos, di lowa ofisas must do wetin dia senior ofisas orda dem to do.
Samaria wimen, una bi fat melu for Bashan! Una dey ponish pipol wey nor strong, wey dey poor and dey opress doz wey dey hongry, den una go tell una husband, “Give us more wine make wi drink.”
“For dis time tumoro, I go send one yong man kom meet yu from Benjamin tribe. Yu go anoint am kon make am king ova my pipol, Israel. E go save dem from Filistia pipol hand. Bikos I don favor my pipol and dia prayers don rish my ear.”