Exodus 3:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English8 I don kom diliver dem from Egypt pipol, den karry dem go anoda land wey dey good and big. Di land wey milk and honey dey flow for di aria where Kanaan, Hit, Amor, Periz, Hiv and Jebus pipol dey stay. အခန်းကိုကြည့်ပါ။ |
True-true, na forty years Israel pipol take travel pass di desert, so all di men wey dey fight wen dem komot from Egypt don die finish for di desert, bikos dem disobey God and God don swear sey as dem disobey am, E nor go let dem si di land wey E don promise to give dem; di land where milk and honey full.