Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 3:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 Wen God si sey Moses don near di bush, E kon koll am, “Moses, Moses!” Den Moses ansa, “I dey here.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 3:4
18 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So afta sometaim, God kon test Abraham. God koll am, “Abraham!” Abraham ansa, “Na mi bi dis!”


But God angel koll am from heaven, “Abraham! Abraham!” Abraham ansa, “Si mi for here!”


Den Jakob wake-up kon sey, “True-true, God dey dis place and I nor know!”


Wen Israel dey sleep for nite, God kon tok to am for vishon sey, “Jakob, Jakob!” E ansa, “Na mi bi dis!”


God don tok many times sey, “All di pawa for heaven and eart, dey my hand


God koll Moses from di mountin kon tell am, “Dis na wetin yu go tell Jakob house and Israel pipol:


Den God angel appear to am like fire for inside di bush. Wen Moses look, e si sey di fire dey katch, but di bush nor dey burn!


Moses kon tell God, “Si, Yu don dey always tell mi sey, ‘Take dis pipol go dat land,’ but Yu neva let mi know who Yu go send follow mi. But Yu sey, ‘I know Yu by yor name and Yu always dey good for my eye.’


God sey, “Dis na wetin yu go do, so dat Israel pipol go bilive sey na di Oga God wey bi dia grand-grand papa, Abraham, Isaak and Jakob God, appear to yu.”


God koll Moses kon tell am from di Tabanako sey:


Den one vois tell am, “Pita, get up, kill make yu chop.”


One day, around three oklok for aftanoon, e si vishon where God angel for koll am, “Kornelius.”


E fall for groun kon hear one vois wey koll en name, “Saul, Saul, wetin make yu dey ponish mi?”


Make good tin full una land and na God goodness go bless dem, bikos na-im tok from di bush wey dey burn. Make dis blessing kom meet Josef tribe, bikos na-im bi leader among en brodas.


Den God kom near and koll am as before, “Samuel! Samuel!” So Samuel ansa, “Tok to mi, yor savant dey listin!”


God kon koll Samuel and e ansa, “Na mi bi dis!”


Den God koll again, “Samuel!” So Samuel get up kon go meet Eli sey, “Si mi here, yu dey koll mi.” But Eli ansa, “I nor koll yu my pikin. Make yu go back go sleep.”


Den God koll Samuel for di third time. E get up go meet Eli sey, “Si mi here, yu bin dey koll mi.” Eli kon know sey na God dey koll di boy.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ