God wey dey mighty, en Spirit dey on mi, bikos E don anoint mi to prish good news give poor pipol; heal doz wey dia heart break; announce make dem release doz wey bi slave and free doz wey dey for prison.
But una nor go komot from di tent gate or una go die, bikos di anointin oil don make una dey holy for God present.” So dem kon do wetin Moses tell dem.
“ ‘Wen dem don pour di anointin oil for High Priest head, e don dey klean to wear di garment wey priests dey wear and e must nor komb en hair or tear en garment.
E must nor komot from di temple or enter where dead body dey, even if na en papa or mama die, bikos e don dey holy thru God anointin oil. Na mi bi Oga God.
As for una, di Holy Spirit wey Christ give una, dey stay inside una, so una nor nid anybody to tish una again. Evritin wey di Holy Spirit dey tish, na true and lie nor dey inside. Just as e don tish una, make una stay inside am.