Wen di priests enter di temple kom out and dem won go outside for di kourtyard, di holy klot wey dem wear take serve God, dem must leave am for dis rooms before dem komot. Dem must wear anoda klot before dem go-go where pipol gada dey wait dem.”
E kon save us. Nor bi bikos wi do good, but na bikos of en mesi. E forgive awa sins and E make us new shidren kon give us new life thru di Holy Spirit.
Dis show how baptizim go save us, nor bi just to wosh dirty komot for pesin body, but na to show sey wi get good mind for God thru di way wey Jesus Christ take raiz-up