“Since dis na di ram to take santify Aaron and en sons, yu go remove di fat for di tail, di fat for di intestine; di fat for di liver and di fat for di kidney. Yu go still remove di fat for di rite leg from di knee go up.
Den e take one bread wey nor get yist from di basket wey dey God present; bread wey dem mix with olive oil and one biscuit kon put dem on-top di fat and di rite leg.