Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 29:22 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

22 “Since dis na di ram to take santify Aaron and en sons, yu go remove di fat for di tail, di fat for di intestine; di fat for di liver and di fat for di kidney. Yu go still remove di fat for di rite leg from di knee go up.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 29:22
14 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Di fat wey dey inside di intestine; di part wey dey di liver top; di two kidney and dia fat, make yu take dem follow Aaron and en sons, den yu go burn dem for di altar.


Make yu take some blood wey dey di altar and some anointin oil, den sprinkol dem for Aaron and en sons body, so dat Aaron and en sons with dia garments, go dey holy.


Make yu take one bread wey get olive oil; anoda one wey nor get and one biscuit from di bread basket wey dem give di Oga awa God.


Yu and yor family go fit chop di breast and di leg wey dem give as special gift and di special kontribushon wey dem give God. Yu go fit chop am for any place wey dey holy. Na yu and yor sons get dis ofrin, bikos na part of di peace ofrin wey Israel pipol give.


Di priest go take one man lamb with di olive oil kon offa am as guilt and sin ofrin to God.


kon give all dis part to God as food ofrin: di fat, all di fat tail wey dem kut komot from near di backbone; all di fat wey kover di animal intestine;


Una go remove all di fat wey dey di animal kon offa am to God for di altar: di fat tail, di fat wey kover di intestine,


Dis na di law for di burnt, korn, sin, guilt, ordinashon and di peace ofrin.


kon give di breast and di rite leg as special gift to God for di priests, just as Moses kommand.


But dia meat go bi yor own, just as di breast and di rite leg bi yor own.


So di pesin take di meat leg kon go put am for Saul front. Samuel kon sey, “Di food wey dem keep, na-im dey yor front naw o-o. Chop, bikos na yu dem keep am for since wen I sey, ‘Make una invite pipol kom.’ ” So Saul kon follow Samuel chop.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ