10 “Make yu bring di melu kom di tent front where dem for dey do meetin, den Aaron and en sons go put dia hand on-top di melu head.
Dem go kill di melu for where God dey for di tent door-mot where dem for dey do meetin.
Yu go take one ram kon sey make Aaron and en sons go put dia hand on-top en head.
Yu go take di sekond ram, den Aaron and en sons go put dia hand on-top en head.
All of us bi like sheep wey don lost and wi dey waka go awa own way. But God gi-am di ponishment wey suppose bi awa own.
Wen yu don do dat one finish, take one small melu and ram wey dey okay,
E go put en hand for di animal head and God go asept am as sakrifice to take forgive en sin.’
E go put en two hand for di goat head kon konfess all Israel pipol evil, sin and sturbones for di goat head, den drive am go di wildaness.
Di man go put en hand for di animal head kon kill-am for di door-mot for di tent where dem for dey do meetin. Den Aaron sons wey bi priests, go rub di blood for di altar four side
E go take di melu go di tent gate, put en hand for di melu head kon kill-am for God present.
E bring di yong melu for di sin ofrin, den Aaron and en sons kon put dia hand for di melu head.
Moses bring di ram for di burnt ofrin, den Aaron and en sons put dia hand for di ram head.
“Levi pipol go put dia hand on-top di two melu head; dem go give one as ofrin to klean demsef and di oda one as burnt ofrin, so dat dem go dey holy.
Di One wey nor dey sin, God make am awa sin, so dat inside am, wi go kon dey good for God eye.