“Wen dem enter di gate where dem go pass go di kourtyard for inside di temple, dem must wear linen klot. Anytime dem dey work for di kourtyard or di temple, make dem nor wear anytin wey dem make with wool.
Before Aaron go enter di place wey holy pass, e must baf and wear di garment wey priests dey wear; wey bi linen robe and short nika, both di belt and di priest kap.
So I advise yu sey make yu buy gold; gold wey dem don polish with fire. Den yu go get plenty money. Make yu still buy white klot from mi kon wear am, so dat dem nor go si yor nakednes again, den buy medicine put for yor eye, so dat yu go fit si.