Make yu put di two stones for di priest garment shoulder, so dat e go stand for Israel sons and Aaron go karry dia name go meet God, just to dey always remind am about dem.
“Make tailor wey sabi design klot, design di chest side wey dem go wear wen dem won go know God mind. Make yu make am like priest garment material: wey bi fine linen wey dem weave with gold, blue, purpol and red wool.
And yu go put di Urim and Tummim inside di Breast Plate, so dat anytime wen Aaron dey go meet God, e go wear am for en chest to know wetin dey God mind.
Make only mi dey yor heart and make I bi like betta ring for yor hand, bikos love strong like deat and feelins for pesin, bi like grave wey nor dey full. E bi like heavy fire and e dey katch well-well.
Dia leaders go kom from dia own nashon and dia prince go bi dia own pipol. E go kom meet mi wen I invite am, bikos nobody go fit kom wen dem nor invite am.