20 Di fourt row go get one chrysolite stone, one onyx stone and one jasper stone. Yu go kover dem with gold for where dem go set dem put.
Di third row go bi one jacint stone, one agate stone and one ametist stone.
Yu go rite Israel twelf shidren names put for di stones and nor-tin go fit klean dem komot.
En hand round like gold with beryl stone and en body bi like elefant horn wey dey shine like safaya stone.
All di four wheel bi like jasper and each one dey shine like gold and dem build dem like sey one wheel dey inside anoda one.
I still si sey dem get four wheel wey bi like each oda and each wheel dey near en creature.
En body bi like yellow jasper and en face dey shine like lite. En eye dey shine like tosh; en hand and leg bi like bronze wey dem polish. En vois alone bi like sey na many pipol dey tok.
Di town get God glory and di way e dey shine, bi like stone wey dear; like jasper stone wey dey shine.
Di pesin wey sidan for di throne bi like jasper and karnelian stone. Rainbow dey round di throne and e bi like sey dem make am with emerald stone.