On-top di flat crystal wey dey dia head, e get one tin wey bi like throne wey dem make with safaya. On-top di throne, wetin dey der, bi like human being.
Yu dey stay for Eden, God gardin. Dem kover yu with fine stones like rubis, diamonds, topaz, beryl, karnelian, jasper, safayas, emeralds and turkwoise. Na gold dem take make evritin about yu and dem make all dis tins for yu for di day wey God kreate yu.