18 Di kourtyard go long rish one hundred and fifty fit kon wide rish seventy-five fit and di top go high rish seven and half fit with dia bronze bottom.
“Make yu still make di Tabanako with ten curtain with fine linen wey dem weave with blue, purpol and red wool. Make yu make di curtains like angel wey get feada and na who dey design go do dis work.