14 Di curtain for di rite side go long rish twenty-two and half fit and yu go support am with three post wey stand for three legs.
“For where dem go pass enter di tent, yu go make fine linen curtain wey dem weave with blue, purpol and red wool kon dekorate am with design.
Di side for di east where dem dey pass enter di kourtyard go wide rish seventy-five fit.
Di curtain for di left side go long rish twenty-two and half fit and yu go support am with three post wey dem stand for three place.
“Den yu go make kourtyard for di tent kon take fine linen curtains kover di sout-side and e go long rish one hundred and fifty fit for one side.
Di curtains for one side long rish twenty-two and half fit, with dia three post and three stand.