33 Hang di curtain under di hook for di tent roof and for di curtain back. Yu go put di Kovenant Box for der. Di curtain go separate di Holy Place from di Holy of Holy.
Di room for inside wey dem dey koll, “Most Holy Place” na di temple back dem build am put. E long rish 30 fit and dem use cedar board take divide am from groun go rish di ceiling.
Make yu guide dem with twenty bronze post kon put dem on-top anoda twenty bronze stand, den hang di curtains with silva hook wey dem join with di silva rod wey join di post.
Aaron and en sons go dey arrange di lamps from morning till evening before di Oga dia God. Dis kommandment na for Israel pipol and dia pikin dem and e go dey forever.”
“Make yu tell yor broda Aaron sey, na di rite time e go-go di place wey holy well-well for di curtain back, bikos na for der I appear for kloud on-top di Kovenant Box. If e nor do am, e go die.