31 “Yu go make one lampstand with gold. Na gold wey dem melt yu go take make di bottom, en leg, cups, di small-small seeds and di flowers go bi di same with am.
Dem dekorate di cedar panels with tins wey den karve and with flowers, den dem use cedar wood kover di inside, so dat dem nor go si di stones wey dey di wall.
Dem dey give God sakrifice wey get betta fine smell both for morning and evening. Dem dey gi-am bread ofrin for klean tabol kon lite di lamp put for di gold lampstand for evening. Wi dey do wetin God sey make wi do, but una don rijet am.
E ask mi, “Wetin yu si naw?” I ansa, “Na one lampstand wey dem make with gold, wey get bowl where dem dey pour oil put. Seven lamps dey on-top di lampstand and each one get seven whole for di wick.
Dia work na to kare for di box, tabol, lampstand, di altars and di tools wey di priest dey use for di Holy Place. Dia work na to kare for evritin wey dey dia list.
Di seven stars wey yu si for my rite hand, na dia sekret bi dis: Di stars na di angels for di seven church and di seven lampstand, na di seven church.”
So, make yu remember where yu from fall and turn from sin kom meet God, den bigin do di tins wey yu first dey do. If yu nor gri turn from sin kom meet God, I go remove yor lampstand from where e dey.
Lite dey shine kom out from di throne and tonda dey make nois from am too. For di throne front, seven tosh wey get fire dey burn for der. Dis na God seven spirit.