Dem put dem for di two side for di “Most Holy Place.” So dia feadas wey dem spread, go tosh each oda for di room middle and di oda two feadas tosh di wall.
Bikos e klear sey, di place wey God give us wey bi en apostles, na where worse pass for di world; wi bi like prisonas wey dem dey go kill. Angels and dis world pipol just dey take us make yeye.
E make dem undastand, so dat thru di church, all di rulers and pawas wey dey heaven go kon know God komplete wisdom, wey dey show ensef for difren ways.
God angels wey kover di place where God dey show mesi and forgive sins, dey on-top dis box. But dis nor bi di time for mi to esplain all dis tins give una.
Dem show sey nor bi demsef dem dey work for, but na for una, bikos una hear dis matter from di apostles thru di Holy Spirit pawa wey kom from heaven. Even angels dey wish sey dem know dis tins.