14 kon take di poles pass inside di rings wey dey di box side, so dat dem go fit use dem karry di box.
Levi pipol karry di box for pole kon put am for dia shoulder, just as God kommand thru Moses, en savant.
David kon sey, “Na only Levi pipol go karry di Kovenant Box, bikos na dem God choose to karry di box and serve am forever.”
Make some pole with akasia wood, kover am with gold
Di poles must dey inside di rings for di box; dem must nor take dem komot.
Di rings go dey near di rim and e go bi di poles wey dem go take dey karry di tabol.
Yu go use akasia wood take make all di poles kon design dem with gold, so dat dem go fit karry di tabol with dem.
Yu go make two gold ring under di borda for di two side, so dat e go hold di poles wey dem go take karry am.
So Joshua wey bi Nun pikin kon koll and tell di priests, “Make una karry di Kovenant Box and seven priests must karry seven ram horn for di Kovenant Box front.”