Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 24:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 So e take di Kovenant Book kon read am make all di pipol hear and dem sey, “Wi dey ready to do and obey all di word wey di Oga awa God tok.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 24:7
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Na only di stone tablets wey God take make Kovenant with Israel pipol as dem dey kom from Egypt, dey inside di Kovenant Box and na Moses put am wen dem dey Mount Sinai.


Dem promise sey dem go serve God kon dey blow trumpet to show sey dem mean wetin dem dey tok.


E sey, “Make una bring my pipol wey dey obey mi kom, doz wey make kovenant with mi with dia sakrifice.


But dem dey lie give God kon dey tok anyhow.


All di pipol ansa, “Wi go do evritin wey di Oga awa God don kommand us.” So Moses go back go meet God kon tell am wetin di pipol tok.


Israel God tell mi sey make I tell di pipol: “I make kovenant with una grand-grand papa wen I take dem komot from Egypt kon free dem from dia sofa. I tell dem sey,


Weda wi like wetin God tok or not, wi go obey di Oga awa God wey wi sey make yu help us pray to. Bikos wi know sey, if wi obey am, evritin go dey well for us.”


“ ‘ “As I dey waka pass again, I kon si sey di time wey yu suppose to undastand wetin love mean, don rish. So, I kover yor naked body with my klot kon promise sey I go always love yu. Yes, I marry yu and yu kon bi my own.” ’ ” Dis na wetin God wey get pawa dey tok.


Nor bi di same papa all of us get? Nor bi di same God kreate all of us? Den why wi dey break awa promise wey wi make to each oda kon hate di kovenant wey God make with awa grand-grand papa dem?


Afta dem don read from di law and di profets book, di oga for di sinagog kon send message go meet dem sey, “Awa brodas, if una get any message to take enkourage di pipol, make una kon tok naw.”


And afta una don read dis leta, make una let di pipol for di church wey dey Laodicea, read am too. Den make una still read di leta wey I rite give dem.


I kommand una with Jesus name sey, make una read dis leta give all di brodas and sistas wey bilive.


Di pipol tell Joshua, “Wi go woship di Oga awa God and wi go obey am.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ