God tell am, “Make yu go stand for my front for di mountin. Si! God dey ready to waka pass.” God send one strong breeze go shake di hills and di rocks, but God nor dey inside di breeze. Afta di breeze stop, di groun kon dey shake and swallow tins, but God nor dey inside.
Wen di pipol si sey Moses nor dey kom down from di mountin, dem gada round Aaron kon tell am, “Make yu make one god for us wey go lead us, bikos wi nor know wetin don happen to Moses wey take us komot from Egypt!”
Afta I don bring Israel pipol kom back to dia land, dis na di new kovenant wey I go make with dem: I go put and rite my law for dia heart. I go bi dia God and dem go bi my pipol.
So anybody wey nor do wetin God kommand and dey tish odas to do as e dey do, naim go small pass for God Kingdom. But pesin wey obey God and tish odas to do wetin di Law tok, na big pesin e go bi for God Kingdom.
E klear sey na Christ rite dis leta by ensef kon send am thru us. Nor bi biro dem take rite am, but na di God wey dey alive Spirit dem take rite am, nor bi for paper, but na for awa heart.
Di ministry wey dem rite for slate bring deat kom and di glory wey follow am, nor let Israel pipol fit look Moses face. If di glory wey dey Moses face, fade bikos e dey under di law,
God tell una dis tins from inside di fire as una gada for di mountin. E shaut tok from di fire wey kloud and darkness kover. Dis na all di tins wey E tok dat time and E rite dem for two stones kon give dem to mi.
But make yu nor follow dem go, yu go dey here with mi, so dat I go fit tell yu all di kommand, rules and law wey yu go tish dem, so dat dem go dey do dem for di land wey I go give dem.”
Di gold altar where dem dey burn incense and di Kovenant Box wey dem kover with gold, dey der too. Di gold jug wey dem put manna, Aaron rod wey grow leaf and di flat stone wey dem rite di law put, dey inside dis box.