Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 24:10 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

10 and dem si Israel God. Sometin wey bi like karpet wey dem take safaya stone make dey under en leg and e klear like sky.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 24:10
28 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So Jakob koll di place Penuel, kon sey, “I don si God face-to-face and I still dey alive.”


E nor fit waka well as e dey pass Penuel land, bikos of en lap wey dey pain am, so sun kon dey beat am.


Mikah still sey, “Naw, make yu listin to wetin God tok! I si God wey sidan for en throne for heaven with all en angels as dem stand near am.


My Oga wey bi Israel God, make Yu keep di promise wey Yu make to yor savant David.


But God nor distroy Israel leaders even doh dem si am kon chop and drink for en present.


E still tell am, “Na mi bi yor papa Abraham, Isaak and Jakob God.” Den Moses hide, bikos e dey fear to look God face.


God still sey, “Yu nor go fit si my face, bikos nobody wey si my face go survive.”


Den I go take my hand komot and yu go si my back, but yu nor go si my face.”


En hand round like gold with beryl stone and en body bi like elefant horn wey dey shine like safaya stone.


“So, who bi dis wey appear like morning lite; wey fine like moon; dey shine like sun kon get stars like soja wey get many rank?”


Before-before, dia prince dem shine pass snow and white pass milk. Dia body smooth pass rubi stone and wen yu si dem, dem dey shine pass safaya stone.


Thirty years afta dem karry us go Babilon as slave, wen I dey stay with my pipol near Chebar River, for di fift day for di fourt mont, heaven open and I kon si one vishon.


I look on-top di creatures wey dey alive kon si sometin wey bi like throne wey dem make with safaya.


I bi like savant wey stand for en oga front. Naw, how I won take tok to yu? I nor get strent to even breath again.”


So I go tok with am face-to-face and nor bi with word wey e nor go undastand and e go si as God bi. So wetin make una nor dey fear to tok against my savant Moses?”


Jesus body kon shange. En face kon dey shine like sun and en dress kon white.


Nobody don fit si God face before. But Jesus, wey bi God ensef, wey en and en Papa bi tait friend, na-im kom show us how God bi.


Jesus ansa am, “So Filip, I don dey with una all dis time and yu still nor know mi? Di pesin wey don si mi, don si my Papa! Why yu kon dey sey, ‘Show us yor Papa?’


(Nor bi sey anybody don si di Papa before, escept mi wey kom from heaven).


Dis God nor fit die and E dey stay for lite wey nobody fit waka near. Lite wey human being neva fit si. Make all honor and pawa bi en own forever and ever. Amen!


Nobody don ever si God before. If wi love each oda, God dey inside us and en love dey pafet inside us.


E whole seven stars for en rite hand and swod wey get two sharp side, dey kom out from en mout. En face dey shine like sun.


Di town get God glory and di way e dey shine, bi like stone wey dear; like jasper stone wey dey shine.


Di pesin wey sidan for di throne bi like jasper and karnelian stone. Rainbow dey round di throne and e bi like sey dem make am with emerald stone.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ