Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 23:6 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

6 “Make una nor give bad judgement to poor pesin for kourt.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 23:6
23 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Make una respet God as una dey take decision, bikos di Oga wey bi awa God nor dey like wayo, bribe or anyhow tins.”


If any of my savant komplain give mi, I dey listin and I dey trit dem well.


E nor good to favor who do bad, bikos good pipol nor go get korrect judgement.


Make yu nor trit poor pipol anyhow bikos yu get pawa! Doz wey nor get help for kourt, make yu nor trit dem anyhow too,


Bikos wen dem drink, dem fit forget di laws kon dey opress poor pipol.


Nor sopraiz wen dem dey opress poor pipol or as bad judgement dey kover good judgement. Dis na bikos, di lowa ofisas must do wetin dia senior ofisas orda dem to do.


Dem dey free pipol wey dey guilty kon opress doz wey dey innocent, bikos dem don take bribe.


Dem don fat and dey chop betta food. Dem nor know wen to stop all di bad tins wey dem dey do. Dem nor dey give doz wey nor get papa dia rite or give betta judgement to doz wey dem dey opress.


I ansa, “Dem bi sturbon and wiked pipol; dia heart strong like bronze and iron. Dem dey lie waka and na so-so bad-bad tins dem dey do.”


Make una stop to opress di strenjas among una; shidren wey nor get papa and mama and wimen wey dia husband don die. Make una stop to kill innocent pipol and woship oda gods, bikos e go distroy una.


“ ‘Make una dey honest and pure wen ever una dey judge any matter. And make una nor dey trit poor pipol matter anyhow kon dey show good face to pipol wey get money.


Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.


Make una nor judge anyhow or judge wetin una nor know. Make di judge dem nor take bribe from pipol, bikos bribe dey blind wise pesin eye kon spoil betta pipol mind.


Strenjas, pesin wey nor get papa and mama or wimen wey dia husband don die, if anybody nor judge dia kase well, na curse go follow am. Den all di pipol go ansa, “Amen.”


But en boys nor follow wetin e tish dem, instead dem dey take bribe and nor dey judge well.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ