Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 23:24 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

24 Make una nor bow or serve dia gods kon do wetin dem dey do. But una must distroy dem finish kon skata dia juju to pieces.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 23:24
29 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Just as di kountries wey God porshu dey do, na so too Israel pipol dey burn incense for all dia juju altar. Di bad tins wey dem dey do kon make God vex well-well.


di kountries wey God porshu bikos of Israel pipol, dem dey follow dem serve dia juju kon dey do all di bad-bad tins wey Israel kings do before.


E distroy di high place dem with dia juju, shrine and Asherah juju. E still distroy di bronze snake wey Moses make, bikos till dat time, Israel pipol still dey offa sakrifice gi-am. Dem dey koll am, “Nehushtan.”


Even doh e nor gri follow God kommand, e nor bi like en papa and mama, bikos e skata di Baal juju wey en papa make.


Wen Amazaya kill Edom pipol finish, e kom back with Seir pipol juju kon make dem en god. E dey bow, woship and sakrifice give dem.


E sin like di oda kings and nashons wey God porshu komot di land for Israel pipol.


But Manasseh deceive Judah pipol and doz wey dey stay for Jerusalem make dem for sin pass di nashons wey God distroy komot der, for dem.


I nor go even tink to do bad tin and I nor go join pipol do bad tins.


Make una nor serve any oda God apart from mi.


Make una nor bow or serve dem, bikos na mi bi di Oga una God and I dey jealous well-well. I bi God wey dey ponish shidren and dia shidren-shidren, bikos dia papa Rijet mi.


“Make una do evritin wey I tell una and una nor go pray or swear to any oda god. Make I nor ever hear dia name for una mout.


“Make una nor enter kovenant with dem or with dia gods.


Make dem nor stay una land, so dat dem nor go make una sin against mi, bikos if una serve dia gods, I go distroy una.”


E take di melu wey dem make, burn am inside fire; grind am to powder kon pour am inside wota and e force Israel pipol make dem drink am.


Yu like as yu dey do di bad tins wey dem do? No! But e nor even tey before yor own worse pass dia own.


Na wikedness full di pipol heart, so dem must sofa for dia sin. God go distroy dia altar kon skata all dia holy pilas.


Make una nor do wetin una do for Egypt where una dey before or for Kanaan land wey I go soon give una or do wetin dia law tok.


God tell dem, “Make una nor make juju for unasef or make image, pila, stone kon dey woship am. Na mi bi di Oga una God.


Dis wimen invite di pipol kom dia juju festival; den di pipol chop and woship dia juju.


una must drive all di pipol wey dey stay di land komot. Make una distroy all dia juju wey dem make with stone or iron and all di place where dem for dey woship di juju.


Make una break di altars and skata di pilas. Make una burn di Asherah juju poles kon kut dia juju. Make una make sure sey una distroy all dia gods!


Dis na wetin una go do. Una must skata di pagans altar kon distroy all dia juju pilas. Make una kut dia Asherah pole for groun kon burn dia juju.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ