Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 23:19 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

19 “Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm to di Oga una God house. “Make una nor kook yong goat wey still dey suck en mama breast.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 23:19
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Evry year, wi go take di first korn wey wi harvest go di temple as ofrin and even di first fruit wey go ripe for awa trees, wi go give dem too.


Wi go karry di first boy pikin wey awa wife born go meet di priest for di temple and dem go dedikate am give God, just as dem rite am for di law. Wi go still dedikate di first melu, sheep, lamb and goat wey awa animals go born.


“Make una nor tok bad about God or curse who dey rule una.


“Make una give mi una plant and wine ofrin. “Una must give mi di first son wey una born.


Una must bring di first fruit wey una harvest from una farm kom di Oga una God house. Make una nor kill or chop animal wey still dey suck breast.”


Raitious pipol dey kare for dia animals, but wiked pipol dey trit dia own anyhow.


Honor God with yor money kon offa di first fruit wey yu harvest from yor farm gi-am.


bikos dia relijon dey yuzles. Dem dey kut wood from forest kon gi-am to pesin wey dey karve and e go karve image with di wood;


Di priests go get di betta part for evry first fruit or food for Israel and evritin where Israel pipol go offa give mi. Anytime di pipol bake bread, dem must give di priests di first bread as ofrin and my blessing go dey dia house.


“Levi shidren go get special place for der and e go dey di sout-side near di priests. E go long rish nine mile kon wide like three and kwota mile for west; di measurement na di same from nort go rish di sout-side.


Di aria wey dem leave for God, must bi di best part for di land and make dem nor sell, shange am or gi-am to anybody. Bikos e dey holy and na God get am.


Una and una shidren-shidren must give God some for di first flower wey una grind as special ofrin forever.


But God don raiz Christ from deat! And E make us dey sure sey, oda pipol go raiz-up from deat too.


Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.


And naw, awa God, wi don bring di first fruit, plants and animal wey Yu give us for dis groun.” Make una put evritin for di Oga una God present, den bow woship am.


make una put some of di first fruits and plant wey una harvest inside one basket kon bring dem kom di place wey God don choose for woship and where dem go for honor en name.


Dis ones nor spoil demsef with wimen, bikos dem bi virgin. Na dem dey follow di Lamb wen e dey go anywhere. God save dem as human being, so dat dem go bi di first fruit wey en and di Lamb plok.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ