17 Three times for di year, all doz wey bi man go-go meet di Oga dia God.
Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am. Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der.
I dey hongry to know God! Di God wey dey alive. So na wen I go take stand for en front?
I dey kry both day and nite and na tears bi di only food wey I dey chop and my enemies dey tell mi sey, “Where dat yor God dey sef?”
Yu dey provide for dem as dem dey travel go di temple and each of dem dey kom meet Yu for Zion.
“Evry year, una go celebrate three times to take honor mi.
Three times evry year, all una men must kom stand before di Oga wey bi Israel pipol God.
Who sey make una dey bring dis animals wen una dey kom woship mi? Who sey make una dey mash round my temple?
Wen Jesus bi twelf years, dem kon go as dem dey do before
but una must woship di Oga una God for where en ensef go choose from among all di tribes and na der una go for honor en name.
For evry year, evry man for Israel go dey celebrate dis three feast: Bread wey nor get yist, Harvest Feast and Shelta Feast. For each feast, evribody must karry gift kom give di Oga una God for di place wey E choose.
wen Israel pipol go kom before di Oga una God for di place wey E choose, yu must read dis law for dem make dem hear.