Wi still promise sey wi nor go buy korn or anytin wey strenjas go karry kon sell for us for Sabat Day or for any oda day wey holy. For evry sevent year, wi nor go plant anytin for di land and wi go kounsol all di debt wey pipol dey owe us.
But for di sevent year, una must allow di land rest and make una leave am, so dat poor pipol wey dey with una, go chop wetin grow for di land and di animals go chop wetin remain. Una must still do like dis for una vineyard and olive farm.
Yu neva take us go any land where milk and honey full or sey yu give us where get vineyard as awa propaty. Yu tink sey yu go fit deceive us? Wi nor go kom.”