7 “If pesin give en neighbour money or propaty to keep for am and dem kon tif di tin for di man house, if dem katch di tif, e must pay doubol.
If dem si wetin e tif for en hand; weda na melu, donkey or sheep and di animal neva die, di tif must pay doubol.
“If fire dey burn for pesin farm kon spread and distroy plant for anoda pesin farm, di pesin wey start di fire go pay evritin wey distroy.
So God sey, “Just as dem dey disgrace tif wen dem katch am, na so too I go disgrace Israel pipol, dia kings, ofisas, priests and profets, bikos of wetin dem do.
Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem.
Den God tell Moses:
“If pesin sin against God wen e nor gri riton wetin e take as shorti from anoda pesin or wen e tif or play wayo,
Di day wey e dey riton dem, e go pay di owner komplete money kon add twenty percent join am.
(Judas tok like dis, nor bi sey e kare for poor pipol, but bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey keep di money, e dey tif from am.)
tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom.