But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”
So una must separate di animal wey dey klean from di ones wey nor klean; di bird wey klean from di ones wey nor dey klean. Make una nor chop dem, bikos I don make una holy.
but instead, make wi rite leta go give dem sey, make dem nor chop food wey dem sakrifice give juju and make dem nor sleep with who dem nor marry, animal wey dem kill and di blood nor tosh groun, make dem nor chop or drink en blood.
Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.