But I ansa, “God wey get pawa well-well, make Yu nor do am like dat! Since I small, I neva chop food wey di law dey forbid or chop animal wey die on en own or wey wiked animal kill. I neva chop any food wey nor klean.”
Anybody wey kom from Israel or strenja wey chop animal wey die on en own or wey anoda big animal kill, must go wosh en klot, baf and e go dey unklean till evening.
“Wen dem just born lamp, melu or goat, e go dey under en mama for seven days, but for di eight day go, dem fit use am as gift ofrin to God and I go asept am.
Make una nor chop anytin wey die on en own. Una fit gi-am to strenja wey dey stay una town or una fit sell am give strenjas. But make una nor chop am at-all, bikos una bi di Oga una God pipol. Make una nor kill or chop small goat wey still dey suck breast.