Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 22:23 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

23 If una sofa dem and dem kry kom meet mi, I go listin to dem.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 22:23
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Dem make poor pipol dey kry to God and E don hear dia koll for help.


Bikos of di opreshon wey pipol dey sofa from strong pipol, dem dey kry for help.


But Yu dey si di trobol and wahala wey dem dey kause. Yu dey si evritin; so make Yu ponish dem. Doz wey nor get help dey trust Yu and na Yu dey fight for shidren wey nor get papa and mama.


But I know sey God go help di pipol wey dem dey opress kon judge well for poor pipol.


Pipol wey dey fear am, E dey give dem wetin dem wont; E dey hear wen dem dey kry for help kon save dem.


But inside my trobol, I kry to God. Yes! I pray to my God make E kom help mi and E hear mi from en temple, bikos my kry rish en ear.


Na en bi papa to di pipol wey nor get papa and na en bi husband to wimen wey dia husband don die. God dey rule from en holy place.


bikos dat na di only klot wey una neighbour get to wear, so dat kold nor go katch am. E get any oda klot wey e go take sleep? And wen e kry kon meet mi, I go listin to am, bikos I dey pity for pesin well-well.


Wi don turn shidren wey nor get papa and awa mama don turn who en husband don die.


una nor tink sey God go help en pipol wey dey kry to am both day and nite? Abi, God go wait tey before E help dem?


Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.


Make una dey kareful, if not wiked tins go full una mind, den una nor go give pesin money, bikos di seven years don dey near. If una nor gri give di pesin money and di pesin kon kry give God, dat mean sey una don kommit sin.


Una must pay dem for dia work evriday wen evening rish, bikos dem poor and dey wait dat money. If una nor pay dem, dem fit kry give God and di sin go dey una head.


Si, di money wey yu nor gri pay di workers wey dey work for yor farm, dey kry against yu and di pipol wey dey gada wetin yu plant, dia kry don rish God ear.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ