Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 22:20 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

20 “Anybody wey sakrifice give anoda god wey nor bi di Oga awa God, dem must distroy am.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 22:20
20 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Profet Elijah tell dem, “Make una hold di Baal profets! Make una nor let any one eskape!” So dem hold di profets and Elijah karry dem go Kishon Valley kon kill dem for der.


Wen e don offa di sakrifice finish, Jehu kon tell di guards for di palis, “Make una enter inside di temple go kill all of dem and make no one eskape!” Di guards and ofisas kill all of dem for der kon trow dia body for outside, den dem waka enter inside di main room for di juju temple.


Dem kon kill both yong and old; boys or girls wey nor gri serve God.


“Make una nor sofa or opress strenjas wey dey stay with una. Unasef know wetin e mean to bi strenja, bikos una bi strenja before for Egypt.


Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”


“Make una dey kareful, so dat una nor go make kovenant with di pipol for di land, bikos wen dem bigin woship and sakrifice to dia juju, dem go koll una make una join dem, den una go chop from dia sakrifice;


I tell dem sey make dem trowey all dia juju and make dem nor dirty demsef with Egypt juju, bikos na mi bi di Oga wey bi dia God.


So make di pipol nor sin against God kon offa sakrifice give dia goat juju. Israel pipol must keep dis law forever.


Make una nor ponish strenjas wey dey stay for una land.


Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.


God hear Israel pipol prayer kon diliver Kanaan pipol to dem and dem distroy dem and dia towns. So dem kon koll dat place, “Hormah.”


Doz wey nor get papa and mama and doz wey nor get husband again, E dey make sure sey E fight for dem. E dey show love to strenjas wey dey stay with una kon give dem food and klot to wear.


But any profet wey tok wetin I nor send am or tok about any oda god, go die.


Di third generashon for Edom and Egypt pipol fit enter God present.


Una must judge well for di strenjas wey dey with una; doz wey nor get papa and mama and woman wey en husband don die. Make una nor ever take dia klot as shorti for debt.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ