Make una nor listin to doz wey dey deceive una, bikos dis tin fit make dem karry una far; go where una nor know. I go drive una komot from una land and una go die for der.
Nor listin to anybody or profet wey sey e know wetin go happen tumoro; doz wey dey undastand dream; doz wey dey koll dead body or doz wey dey do majik; wey sey make una nor respet Babilon king.
“ ‘Man or woman wey dey woship dead body spirit, dem must kill dem. Dem must stone dem die and anybody wey do dis tin go sofa di ponishment for en sin.’ ”
Naw, Samuel don die and evribody for Israel dey mourn. Dem beri am for en town for Rama. For dis time, Saul don porshu all di majik pipol and doz wey dey si vishon komot di town.
Di woman ansa am, “Si! Yu know wetin Saul don do; e don porshu di pipol wey dey si vishon and doz wey dey do majik komot from di land. So why yu dey kom try mi, so dat dem go kill mi?”