15 If di owner dey with am, di man nor go pay anytin, bikos wetin e pay take hire am kover di money.
Make una ask mi for big bride prize and gifts and I go give una evritin wey una ask for. All I wont na make una give mi una sista as my wife.”
“If pesin borrow animal from en neighbour and e kon wound or die wen di owner nor dey with am, di man must pay back.
“If pesin deceive girl wey neva no man and e kon sleep with am, e must pay di bride prize kon marry di girl.
Before dat time, nobody get money to hire men or animals and nobody dey save from en enemies, bikos na mi God turn pipol against each oda.”
Di man wey rape di woman go pay 50 silva give di woman papa and di woman go bi en wife, bikos e don dis-virgin am. E nor go ever fit porshu di woman komot en house till e die.