11 di neighbour must swear to God sey, e nor get hand for di matter and di owner go asept en word and e nor go pay anytin.
“If pesin give en neighbour one donkey, melu, sheep or any oda animal to keep for am and e kon die, wound or pesin tif am and e nor know,
But if dem tif am from am, e must pay di owner back.
But if dem nor katch di tif, den di owner of di house go-go stand make dem judge am, weda naim take en neighbour propaty.
“Make una nor dey tok wetin una eye nor si. Make una nor join wiked pipol lie for pesin head.
Bikos if I too get money, I fit deny Yu sey, ‘Who bi God?’ And if I too poor, I go fit go tif kon bring shame for yor holy name.
So since yu don promise God sey yu go dey loyal to am, den make yu obey di king kommand.
“ ‘If dem koll yu make yu kon tok about sometin wey yu si or wey happen for yor present and yu nor gri, yu don sin bi dat and dem must ponish yu.
or e si sometin wey lost kon lie and swear sey e nor si am, e must give ofrin.
Wen pipol won setol matter, dem dey swear with pesin wey big pass dem and di agriment wey dem make, dey end di matter.