35 “If one man melu wound en neighbour melu and e die, den di two pipol go sell di melu wey dey alive kon share di money and dem go still share di melu wey die too.
Or if pipol know sey di melu dey always attack odas and dem tell di owner and e nor do anytin koncerning di matter, e must use di melu take pay, den di one wey don die, go bi en own.”