Esau still sey, “En name really na Jakob! E don kollect two tins for my hand naw! E first kollect my rite as senior and naw si, e don take my blessing!” Den e ask en papa, “Yu nor keep any blessing for mi?”
One day, one woman wey en husband bi profet before e die kon kry go meet Elisha sey, “Yor savant my husband don die. Yu know sey yor savant dey follow God kommand. Naw, doz wey e dey owe money before e die, won kom take my two sons as slave.”
I kon sey, “Just as wi fit, wi don dey buy awa Jew brodas wey sell demsef give strenjas back. But naw, una by unasef won sell una own brodas! So how many times wey go buy dem back?” But di leaders kwayet and nor fit defend diasef.
“But if na for day time dem kill di tif, di tif blood go dey who kill-am head. “Tif wey dem katch must pay evritin wey e tif. If e nor get anytin, den dem go sell am take pay for wetin e tif.
Make una nor si am as big lost wen una free una savants. Make una remember sey, di work wey dem don work for una for six years, if una sey make una hire pesin make e do am, una go pay am times two. So di Oga una God go bless una for dis tin wey una do.
Moses kommand dem: “For di last day for evry seven years, for di rite time for di year wey dem dey kansol pipol debt, durin di time wey dem dey do Shelta First,