Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 20:8 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

8 Make una remember to keep di Sabat Day holy.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 20:8
22 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

For di sevent day, God finish di work wey E dey do and E kon rest.


God bless di sevent day kon make am holy, bikos na dat day E stop all di work wey E dey do since.


For dat time, I si pipol for Judah dey make juice from grapes for Sabat Day. While some dey load korn, wine, grapes, figs and oda tins on-top dia donkey kon take dem go Jerusalem. So I warn dem sey make dem nor sell anytin for Sabat Day.


Yu tish dem sey make dem keep di Sabat Day holy kon give dem yor laws thru yor savant, Moses.


“Una go work for six days, but make una nor work for di sevent day, so dat una melu, donkey, slave and strenjas wey dey work for una, go rest.


Moses gada Israel pipol kon tell dem, “Dis na di word wey God sey una must do.


I go bless pipol wey always dey keep di Sabat Day and obey di kommand. I go bless doz wey nor dey do wiked tins.”


God sey, “If una keep di Sabat Day holy and una nor run follow wetin una wont dat day; if una value my holy day and honor am and una nor travel, work or tok yeye word for dat day,


God sey, “If una value una life well-well, for Sabat Day, make una nor karry any load pass di gates for Jerusalem


or bring anytin kom out from una house or do any work. But make una si am as holy day for God, just as I kommand and tell una grand-grand papa dem.


“God still sey, ‘Una must obey all wetin I kommand. Una must nor karry load pass di town gates for Sabat Day. Una must si Sabat as holy day and una nor go do any work for dat day.


Make una keep di Sabat holy, so dat e go bi sign for di kovenant wey wi make and e go remind una sey na mi bi di Oga wey bi una God.’


Each of una must respet en papa and mama and una must keep my laws. Na mi bi Oga una God.


“ ‘Make una keep di Sabat Day and honor di house where una for dey woship mi. Na mi bi God.


“ ‘Una go work for six days, but di sevent day, na di day wey una suppose rest. For dat day, una nor go work, but una go gada woship God.


Una must keep di Sabat Day and honor di place where dem for dey woship mi. Na mi bi Oga God.


Wen Israel pipol still dey for wildaness, dem si one man dey pak wood for Sabat Day.


Una must obey di Sabat Day, just as di Oga una God kommand una.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ