Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 20:7 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

7 Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos I go ponish anybody wey do like dat.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 20:7
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

But Isaak ask en pikin, “Na how yu take kill di animal just naw just naw?” Jakob ansa, “Na di Oga yor God help mi.”


But naw, nor si am as innocent pesin. Yu bi man wey get wisdom, yu know wetin yu go do am. Make sure sey dem kill-am.”


Gehazi wey bi Elisha savant kon tink for en mind, “Si, my masta nor gri take wetin Naaman bring kom. As far as God dey alive, I go run go meet am kon kollect some tins for mysef.”


Dem nor gri do wetin Yu kommand; dem like to dey do wiked tins and awa enemies dey like to lie well-well.


Bikos if I too get money, I fit deny Yu sey, ‘Who bi God?’ And if I too poor, I go fit go tif kon bring shame for yor holy name.


But naw, una don shange again and una nor gri respet mi. All of una don take di slave wey una don free before back kon force dem to serve una again.


den, na only my name una go take swear sey, ‘As long as God dey alive, wi go do wetin wi promise’, den all di nashons go praiz mi and I go bless dem bikos of una.”


I go make sure sey Israel, my pipol know my holy name and I nor go let dem disgrace my name again. Den di pipol go know sey na mi bi di God wey dey holy.”


Make una nor lie with my name kon promise pipol, bikos una go disgrace my name. Na mi bi di Oga una God.


Oga God sey, “I go judge pipol wey dey do majik; doz wey dey sleep with who dem nor marry; pipol wey dey tok wetin dia eye nor si; oga dem wey nor dey pay dia workers; doz wey dey opress wimen wey dia husband don die, shidren wey nor get papa and mama again and strenjas. Dem dey do like dis, bikos dem nor dey fear mi.


Na God bi my witness, bikos E know my heart! Na bikos I nor won disturb una naim make mi nor go Korint again.


Una must fear di Oga una God kon woship and love am. Wen una swear, e go must bi with en name.


Make una nor use di Oga una God name take make yeye, bikos God nor go sorry for anybody wey use en name anyhow.


Una must fear di Oga una God kon serve am. Una must use only en name take swear.


My brodas and sistas, make una remember dis kommand pass oda ones; make una nor swear, weda with heaven or eart or any oda tin. But make una let una “Yes” bi yes, and una “No” bi know, so dat una nor go fall enter God judgement.


So make una promise and swear with God name sey, bikos I dey good to una, una go dey good to mi and my family. Make una promise sey


Di men kon tell am, “Di promise wey wi promise nor go do us anytin unless sey yu do as wi sey make yu do:


Wi must let dem live, so dat wi nor go put curse for awa head.”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ