Dem kwik-kwik turn komot from di way wey I kommand dem o-o! Dem melt gold take make melu for demsef and dem don dey bow and offa sakrifice to am sey, ‘Israel pipol, dis na awa god wey take us komot from Egypt.’ ”
Israel pipol, na una bi my witness. I choose una as my savants, so dat una go know, bilive and undastand sey na mi bi di only God. E nor get any oda god wey dey apart from mi. E neva dey before and e nor go ever dey.
So my pipol, make una nor fear or shake! Una know sey from biginnin kon rish naw, I always dey tok di tins wey go happen and una bi my witness. E get any oda god apart from mi? E nor get any oda god, wey get pawa. I neva si or hear about any one?
I send my savant, di profets kom meet una sey make una stop di bad tins wey una dey do kon do di korrect tin. Dem warn una sey make una nor woship and serve oda gods, so dat una go kontinue to stay for dis land wey I give una and una grand-grand papa, but una nor gri listin or hear dem.
But wi (wey bi Christian), na only one God wi get and naim bi awa Papa. Na-im kreate evritin and wi dey live for am. Na Jesus Christ bi awa only Oga God. Na-im make evritin and na thru am wi get life.
One tin wey una must know bi sey, pesin wey dey sleep with who e nor marry; wey nor dey pure or wey get long-trot and dey serve juju, nor go enter Christ and God kingdom.
Dem go end for hell; na dia belle bi di god wey dem dey serve. Tins wey suppose make dem shame, naim dey make dem happy and na only tins for dis world dem dey tink about.
Make una nor let doz wey dey pritend and woship angels judge una. Dat kind pesin dey tok anyhow about vishon wey e sey e si, but na yeye tins and sin full en mind.
So, I kon bow make I for woship di angel, but e sey, “Nor do dis tin! I bi savant and broda like yu wey whole di trut about Jesus well. Make yu woship only God, bikos na di profesy spirit bi di true word about Christ.”
But e tell mi, “Nor do like dat! I bi savant like yu, like yor brodas di profets and doz wey go obey di words wey dey dis book. So make wi woship only God!”
Den I tell una sey, “Na mi bi una Oga and God. Una must nor woship Amor pipol gods; even doh una dey stay dia land naw.” But una nor gri listin to mi.’ ”