Di man kon ask, “Wish one for di kommandment?” Jesus ansa, “Make yu nor kill, nor sleep with pesin wey nor bi yor wife, nor tif, nor tok wetin yor eye nor si,
Den some sojas kon still ask am, “Wot of us? Wetin wi go do?” E tell dem, “Make una nor use force kollect money from anybody hand or lie for anybody head and make una salari, rish una.”
Di law na for pipol wey dey sleep with who dem nor marry; man wey dey sleep with man; woman wey dey sleep with woman; pesin wey dey sell pipol as slave; lie-lie pipol; doz wey dey promise and dem nor fit do am or anybody wey nor dey obey di rite tishings
My brodas and sistas, make una nor tok bad about each oda. Anybody wey tok bad or judge en broda or sista for Christ, e dey tok bad about di law and e dey judge di law. But if una judge di law, den una nor dey obey di law, but una don bikom di law judge bi dat.