Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 20:15 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

15 Make una nor tif.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 20:15
25 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

“Anybody wey kidnap and sell pesin or dem katch di pesin for en hand, dem must kill-am.


God hate pipol wey dey play wayo, but E dey love doz wey dey do good tins.


Make una nor opress or play una neighbour wayo. Make una nor make una worker wait until di next day, before una pay dem.


God sey, “Propaty wey dis pipol use wahala and wayo get, na-im dem pak full dia house and dem nor even dey tok trut or do wetin dey rite.”


Dia hand dey only like to do bad tins! Doz wey bi ofisas and judge, na only bribe dem wont. Doz wey get pawa, dey use am get wetin dem wont.


Na from pesin heart bad-bad tins dey kom out and na dis tins dey make dem kill; sleep with who dem nor marry; tif; lie and judge pesin for en back.


Di man kon ask, “Wish one for di kommandment?” Jesus ansa, “Make yu nor kill, nor sleep with pesin wey nor bi yor wife, nor tif, nor tok wetin yor eye nor si,


Jesus kon tell dem, “God word sey, ‘Dem go koll my house, “Prayer House” ’, but una don turn am to where tif dey hide put!”


(Judas tok like dis, nor bi sey e kare for poor pipol, but bikos na tif e bi. As e bi sey naim dey keep di money, e dey tif from am.)


Di law get difren-difren kommand like, “Nor kommit adultery; nor kill pesin; nor tif; nor put eye for anoda man propaty.” All dis na just one kommand wey sey, “Make pipol love odas, just as dem love diasef.”


tif; long-trot; drunkard; doz wey dey curse pipol and doz wey dey play wayo; non of dem go enter God kingdom.


Pesin wey dey tif, make e nor tif again. Instead, make e work hard and do good with en own hand, so dat e go fit give pipol wey nor get.


If una katch pesin wey kidnap anoda Israel pesin kon dey trit am like slave or sell am, di pesin wey kidnap anoda pesin, must die. Like dis, una go remove bad-bad tins from among una.


Make nobody shit en Christian broda or make am vex, bikos na God go fight for di pesin wey yu shit and wi don tell una before and wi still dey warn una sey, God go really ponish pipol wey dey do like dat.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ