Manasseh still kill many innocent pipol and dia blood don stain Jerusalem from one end go rish di oda end. E even still dey enkourage Judah pipol to sin against God.
Di king forget di love wey Priest Jehoiada wey bi Zekaraya papa show am kon kill en pikin. Wen Zekaraya dey die, e shaut kry sey, “Make God si and ponish una for dis tin wey una dey do!”
But if di melu dey always take en horn wound pipol and dem don warn di owner before and e nor do anytin koncerning di matter, before di melu kon kill pesin, dem must stone di melu die kon kill di owner too.
bikos God dey kom from where E dey stay for heaven kon ponish pipol bikos of dia sins. Di eart go show all di innocent pipol blood wey dem share on-top am and e nor go ever forget di innocent pipol wey dem kill.
Di man kon ask, “Wish one for di kommandment?” Jesus ansa, “Make yu nor kill, nor sleep with pesin wey nor bi yor wife, nor tif, nor tok wetin yor eye nor si,
Yu know di kommandment; nor kill pesin, nor sleep with pesin wey yu nor marry, nor tif, nor lie for pesin head, nor shit pesin, respet yor papa and mama.”
Yu know di kommandment dem wey sey, ‘Make yu nor sleep with pesin wey nor bi yor husband or wife, nor kill pesin, nor tif, respet yor papa and mama.’ ”
Wen di pipol wey dey stay der si sey di snake put e mout for Paul hand, dem kon dey tell demsef, “E bi like sey dis man hand nor klean! Even doh e nor die inside sea, hand don still tosh am for here!”
Di law get difren-difren kommand like, “Nor kommit adultery; nor kill pesin; nor tif; nor put eye for anoda man propaty.” All dis na just one kommand wey sey, “Make pipol love odas, just as dem love diasef.”
bad belle; killi-killi; to dey drink anyhow and dey do oda tins like all dis ones. I dey warn una naw as I don warn una before sey, pipol wey dey do dis kind tins, nor go enter God kingdom!
God nor give di law, bikos of good pipol, but na for pipol wey dey disobey and do anyhow. Dis kind pipol dey like to sin and dem nor dey fear God. Dem nor dey holy or get respet for anytin and dem fit kill dia papa, mama or anybody.
Bikos di same God wey sey, “Nor sleep with who yu nor marry,” naim still sey, “Nor kill anybody.” If yu nor sleep with who yu nor marry, but yu kill pesin, yu don break di law bi dat.