2 Di woman get belle kon born boy. Wen e si sey di pikin fine well-well, e kon hide am for three mont,
Di boy dey inside God temple for six years, wen Atalaya dey rule.
Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow.
Amram marry en papa sista, Jokebed and e born Aaron and Moses. (Amram stay for one hundred and thirty-seven years, before e die).
Amram wife name na Jokebed, Levi dota wey dem born for Egypt. Di woman born Aaron, Moses and dia sista Miriam give Amram.
Na dat time dem born Moses and God kon like am well-well. Moses stay for en papa house for only three monts
Make good tin full una land and na God goodness go bless dem, bikos na-im tok from di bush wey dey burn. Make dis blessing kom meet Josef tribe, bikos na-im bi leader among en brodas.
Na faith make Moses papa and mama hide am wen dem born am, bikos dem si sey di pikin fine and dem nor fear to disobey wetin di king kommand.
So Jesse send for am. Di boy fine well-well, e strong and get fine eyes. God kon tell Samuel, “Na en bi dis! Make yu go anoint am!”