Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 2:14 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

14 Di man ansa, “Who sey make yu kom judge us? Yu dey plan to kill mi as yu take kill dat Egypt man?” Den Moses kon dey fear, so e tink kon sey, “True-true, pipol don know wetin I do.”

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 2:14
17 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

Abram kon tell Lot, “Make mi and yu nor kworel and make awa men nor kworel too, bikos wi bi brodas.


Dem kon shaut gi-am sey, “Komot for awa front, yu wey bi strenja for dis place; na yu won tell us wetin wi go do! Wetin wi go do yu go worse pass wetin wi go do dem.”


Jakob sons kom di town where dem for kill all di men kon pak dia propaty and skata di town, bikos dem don disgrace and rape dia sista.


Wen king vex, e bi like lion wey dey shaut, but if e favor yu, e bi like rain wey dey fall.


E dey bad to borda yorsef about wetin pipol dey tink about yu, but if yu trust God, yu go dey save.


Di one wey yu take us komot from Egypt wey get milk and honey neva rish yu? Yu still won kill us for di wildaness as yu dey trit us like yor savant?


Dem gada against Moses and Aaron kon sey, “Una own don too mush sef! Di kommunity dey holy; na God get am and E dey with all of us too. Why e kon bi sey yu Moses go dey karry body for God pipol?”


Afta Jesus enter di temple, di priest oga dem and di eldas kon ask am wen e dey tish sey, “Na wish pawa yu take dey do all dis tins and who give yu di pawa?”


But Jesus ask am, “My friend, na who make mi judge for una two matter?”


“But e own pipol nor like am, so dem kon send message follow am sey, ‘Wi nor wont dis man to bi awa king!’


But doz my enemy wey nor wont make I bi dia king, make una go bring and kill dem for my front!’ ”


“Dis Moses wey dem rijet and ask sey, ‘Who make yu awa oga and judge’, naim God kon send make e bi oga and Savior thru di angel wey appear to am for bush.


Na di same faith make Moses komot from Egypt and e nor fear di king vexnashon, bikos e get hope for God wey ordinary eye nor fit si.


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ