Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 2:11 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

11 Wen Moses don mature, e komot go visit en Hibru pipol. For der, e kon si how en pipol dey sofa, bikos of di work wey dem dey do. Den Moses si as one Egypt man dey beat one Hibru man wey bi en own pesin.

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 2:11
13 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

So dem kon dey sofa and ponish Israel pipol. Na Israel pipol build Pitom and Rameses as di place wey Fero go dey keep tins put.


God kon tell am, “True-true, I don si how my pipol dey sofa for Egypt. I don hear dia kry for help and I know how dia sofa big rish.


Fero pipol kon bigin beat Israel pipol wey dem take do oga ova dia own pipol, den dem ask dem, “Why una nor komplete una work yestiday and today, just as una dey do before?”


Den di king tell dem, “Moses and Aaron, na una dey make di pipol nor gri do dia work, abi? Make una go back go kontinue una work.


Una pipol don too many for dis land pass Egypt pipol. And naw, una wont stop work.”


Make una give dem strong work, so dat dem nor go get shance to listin to lie-lie word!”


“So tell Israel pipol sey, ‘Na mi bi Oga God and I go remove di load wey Egypt pipol put for dia head and dem nor go bi slave again. Na my pawa I go take save una and I go ponish Egypt pipol.


I go take una as my pipol and I go bi una God. Den una go know sey na mi bi di Oga wey bi una God. Di One wey save una from Egypt pipol hand wen dem dey sofa una.


Nor bi dis kind fasting I choose; but wetin I wont bi sey: ‘Make una remove sin from una body kon give betta judgement, den free pipol wey una dey opress.


Una wey don taya and karry heavy load, make una kom meet mi and I go give una rest.


“God Spirit dey my body, bikos E don anoint mi make I prish Good News give poor pipol. E send mi make I prish freedom give pipol wey dey prison and make blind pipol for si. E still sey make I free doz wey dem dey opress


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ