Biblia Todo Logo
အွန်လိုင်း သမ္မာကျမ်းစာ

- ကြော်ငြာတွေ -




Exodus 18:4 - Holy Bible Nigerian Pidgin English

4 and Elieza (wey mean, “Na awa papa God help and save mi from Fero”).

အခန်းကိုကြည့်ပါ။ ကော်ပီ




Exodus 18:4
19 ပူးပေါင်းရင်းမြစ်များ  

una papa God wey go help una, di God wey get pawa wey go bless una with di blessing wey dey di sky for up; di Pesin wey get blessings wey dey wota and under di eart and even di ones from animals.


Elieza born only Rehabaya, but Rehabaya born many shidren.


My God, I love Yu well-well and na Yu bi my strent.


kon save mi from my enemies. E keep mi for where my enemies nor go for fit tosh mi kon save mi from wiked pipol.


I pray to God and E ansa mi kon free mi from all my fear.


Na God bi di strong place wey wi dey hide put and na-im dey help us wen wi dey trobol.


So Fero tell Moses, “Make yu komot from where I dey and nor ever kom si mi again, bikos any day wey yu si my face again, yu go die!”


Wen Fero hear about di matter, e kon dey fine Moses make e kill-am. So Moses run from Fero go Midian land kon go stay near one well.


Moses wife born boy and Moses koll am, “Gershom” bikos e sey, “Na strenja I bi for dis land.”


Den Moses take en wife and pikin, karry dem put on-top donkey kon go Egypt. Moses hold di stik wey God gi-am for en hand.


My God send en angel kom klose di lion dem mout, so dat dem nor go tosh mi, bikos E si and know sey I nor do anytin. And I neva still do any bad tin to yu, my king.”


Wen Pita si sey all dis tins wey dey happen nor bi dream, e kon sey, “Naw I know sey, True-true, God send en angel kon save mi from Herod hand and from all di tins wey di Jew pipol tink sey go happen.”


Wen di man tok like dis, Moses run go Midian, anoda land where e stay as strenja kon born two boys for der.


But God dey for my side and E give mi pawa, so dat thru mi, Gentile pipol go hear di Good News and Christ don save mi from lion mout!


kwensh fire wey dey burn well-well and eskape wen dem won kill dem with swod. God turn dia weakness to pawa. Dem strong well-well for war front and sojas from oda kountries, dey run from dem.


So make wi get mind wey go make us fit sey, “Na God bi my helpa, so wi nor go fear. Wetin human being go fit do us?”


ကြှနျုပျတို့နောကျလိုကျပါ:

ကြော်ငြာတွေ


ကြော်ငြာတွေ